Na the 7 business be this wey dey work for my area:
*1. Data / Airtime Business*
Everybody dey buy data everyday. You fit start am with ₦20k for phone. Profit small small, but e dey enter everyday.
*2. Pure Water / Cold Drink*
If you get freezer for house, you don get shop be that. For hot afternoon, people must buy cold water.
*3. Provision For House*
Buy small Milo, milk, sugar, biscuit, Maggi put for house. Neighbours go dey come buy am instead of waka go market.
*4. Okpa / Moi Moi / Akara For Morning*
For morning, people wey dey go work no get time cook. If you dey sell hot akara or moi moi, dem go buy am quick quick.
*5. Charging Point + Phone Accessories*
If light no dey stable for your area, just buy power bank and extension. People go pay ₦200 to charge phone. Add earpiece and charger, money go dey enter.
*6. Selling Of Recharge Card And POS*
POS machine no cost again. If you put POS for front of house, people go dey come withdraw. ₦100, ₦100 go turn big money for month end.
*7. Selling Cooked Food For Workers*
Rice and stew for afternoon. Workers for site and shop no dey cook. If your food sweet, dem go be your customer everyday.
My advice be this: No wait till you get big money before you start. Start with wetin you get for hand. Small money wey dey enter everyday pass big money wey you dey wait for.
Which one among these 7 you fit start this week for your ho
use? Tell me for comment.
You must be logged in to post a comment.