â How I made 100k in one week đŻâ
Â
I be Imo boy. I no be PH boy, make we clear am first. If you call me PH boy again, I go report you to my village people for Owerri.
Â
I come PH come hustle, but my OPay balance na the real comedy. Anytime I open am, e dey tell me "Hi Hi Hi" - like say e dey laugh me.
Â
My OPay no dey ever get alert wey pass âŚ500. If âŚ1,000 enter, I go do thanksgiving. My friends go think say I don blow.
Â
So I start to find how boys dey make money with phone for Naija. And na wetin I find be this:
Â
First, I go try those games wey dey Facebook. Dem go tell you "You don win âŚ90,000, just pay âŚ2,000 to unlock am." My brother, I no pay. Na my data I take play the game, dem still want collect my money? Na scam.
Â
Second, I go try one app wey dem say e dey pay direct to OPay. Na Hawkit. That one no be scam. E no go make you rich, but at least e dey pay. You do small task like follow person for Instagram, comment, you go see âŚ100, âŚ200 enter. E small, but e better pass zero. I fit withdraw âŚ100 sef, no wahala.
Â
Third, na this Lodpost wey you dey read now. Dem say if people read your article, dem go pay you. So I say make I write my own wahala make una read am. If you dey read this one now, you don already help my OPay. God go bless you.
Â
Make I tell you truth wey nobody go tell you for TikTok: No app go pay you âŚ10k daily direct to OPay. If e easy like that, everybody for Owerri and PH for don be millionaire. All those "âŚ5,000 don land" videos na acting. Na dem dem dey use your data chop money.
Â
But if you combine small small, e go enter.
Â
Morning: Do 2 Hawkit tasks.
Evening: Write 1 Lodpost article like this one.
Night: Pray make your village people no block your blessing.
Â
If you be Imo boy or PH boy wey your OPay dey cry like my own, comment "Hi Hi Hi" for comment section make I know say I no dey alone.
Â
And abeg, share this article to your WhatsApp status. No be for me, na for your own OPay future. Because if my article blow reach 10,000 views, I go buy data for myself and I no go dey disturb you again.
Â
We move,And keep hustling đ
You must be logged in to post a comment.